Voluntary Medical Male Circumcision (VMMC ) dey among the tools wey fit help reduce the risk of getting HIV. I go tell you why!

When dem born a male child, the penis dey get wetin oyibo’s dey call foreskin, that thing nah en dey cover the main penis, that foreskin as e cover the main penis, that place go come black and moisty so any germ fit go hide for there so tey and as the germs dey hide plenty for there to get the HIV go come dey easy. E never finish ooo, you know say that foreskin no strong reach the main penis? Yes e no strong so if you dey get sex the foreskin fit go scratch come get wound and as you don get wound my brother my sister you don dey at risk ooo.

Now you don see say this VMMC wey oyibo talk say nah Voluntary Medical Male Circumcision dey very essential for HIV prevention Response, so I dey encourage our papa Dem, our mama, our pastors and Alfa Dem even our community leaders Dem make Dem stand up support our nation and our children as nah Dem be the leaders of tomorrow, make Dem dey do Male Circumcision for their male children.

Ebere Kingsley – 2022 LeNNiB Champion